I rilli lof you my dia



I lof you
I rilli do, I sware
Nobodi fit make my hart
Dey beat gidigba
For my shest
But you my deer

You wan no wettin?
Weda I fit dye for u?
Why not my deer
I fit do anytin for you
In fact go bring the cloth now
I go dye am no matter the time

I won spend all my moni
On top of my lof for you
Make I carry you go
Mr. Biggings
I go buy you meetpye
Cake and coke, I sware

Wetin consine Silifa
Consine awa lof?
The lof wey we haf wey pass jollof
Her time don pass
She don comot
Efen my first wife
No get mout for dia

Na you be my lof
I go buy u anytin you want
I go do paming and jerry for your head
I go buy you to mash shoe and bag

Just say u go marri me
My dia
If I no carry you go
My families houses
Make you say
My name no be Suraju

I lof you my dia
I rilli do
Na your lof dey kill me like beer
Na on top your head I go die

Comments

  1. I, i, i, i lof u tu miss haywire. U no blive mi? I fit go swear 4 ma mama grave (bt she neva die sha)I, i, i, i lof u tu miss haywire. U no blive mi? I fit go swear 4 ma mama grave (bt she neva die sha)

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular Posts